Home Headlines Buhari Must Go : A Satire

Buhari Must Go : A Satire

0
449

—————————-
Make una hear this tory wey i wan yarn
Fulani man is wicked. Buhari must go.
In fact, i regret voting for you Buhari.
In less than three months, your cup don full
And i will lead a campaign against you.
Now, who told you we are tired of blackout?
Without revival, NEPA don born again!
My fridge dey work, TV dey work,
As dem dey work all the time dem fit spoil!
My generators don retire, dey gather dusts.
I nor even know where my jerrycans dey sef
Filling station attendants no see person give dem N20, N50 bribe again.
Buhari see yoursef? Who send you message?
Warri and Port Harcourt Refineries don dey work
Kaduna Refinery too go soon join.
So wetin go happen to our darling oil cabals
Wetin go sele to the subsidy regime?
If u get liver, try d cabals if we no go para!
Abi you no know say dem be saints?
Cockroach too dey enjoy Awilo music o,
Na fowl no allow am commot kon dance!
Our Otuoke brother say Stealing no be corruption.
Daura man say stealing na corruption.
Buhari, abi you chop winch?
PhD for Zoology dey talk
You common WAEC dey blow grammar
Ok, before you go far, show me your certificate
Show me where e dey for Koran say stealing is corruption.
You see say this Fulani man no serious at all!
Walai Buhari, your fowl nor fit do nada
For corn wey dey inside bottle!
Also you no allow your wife chop Nigeria money.
How monkey head be wey gorilla own no be?
Every first lady chop Nigeria money.
Maryam Babangida chop. Maryam Abacha chop!
Stella Obasanjo wak. Turai sef lick!
And …and Dia is Godu o even chop, shit for bodi!
Make your wife chop her own, you say no.
Fulani man wicked. You must go.
Bekos na only you waka come!
Who send you message go NNPC?
Now we dey hear how billions upon billions waka
This one wey you start
You go know say kerosene no dey sleep
Buhari nearly destroy our churches
Your elections kon show us say
Some prophets and pastors are liars
Some be original chop and quench!
Some be original chop and clean mouth!
Dem say God TOLD dem say Buhari go lose
How dia own god sabi blow lie i no sabi!
Buhari!
Buhari!
Buhari!
How many times i call you?
You go hear gburugudu gburugudu gburugudu today!
No be how dem dey take chop corn
Dem dey take chop groundnut o!
You no get ministers, Nija still dey work
EFCC don wake, thieves dey enta admission!
Subuanalai, we don taya for you. Kon dey go.
Culled from Odebiyi Amos FB page

Latest News
Stanbic IBTC Capital Named Nigeria's Best Investment Bank at 2026 Global Banking and Finance Review AwardsNNPC Seals Six Gas Deals To Boost Industrialisation, Energy SecuritySenate Queries N943m Allowances Paid to North-West Development Commission BoardStanbic IBTC Bank's Economic Forum Charts Nigeria's Path Through A Shifting Global EconomyTHE YEWA AWORI SOCIO-ECONOMIC BLUEPRINTS FOR THE YAYI ERA AND BEYONDEMHF Opens Heritage Event Hall, Unveils Vision For Africa’s Premier Music Heritage CentreNigeria’s Youngest Chartered Accountant, 16-Year-Old Danielle Osasere, Honoured At MFM Prayer CityThe Kick Of A Dying Horse: Rejecting The Retrogressive Agents Of Darkness In YEWA-AWORI LandNigerians Must Embrace Production, Entrepreneurship To Become Great- Emir of DutseTASFUED Holds Formal Investiture Ceremony for Sixth Substantive Vice-ChancellorOlodo Uprising: Carter Efe mirrors our collective disaster“I’m No Fraudster” — Adeyemi Fires Back at Presidency Over PFIPC ControversyPresident Tinubu Urges Nigerian Media to Prioritise Credibility Over ClickbaitPresidency Disowns Alleged Fake Presidential Council, Says Suspect Facing Fraud ChargesStanbic IBTC Bank Nigeria PMI®: New Orders Continue To Rise Sharply In June